Wetin Dey About Rukewe and Julie ?














Rukewe and Julie na di adaptation of William Shakespeare Romeo and Juliet for Nigerian Pidgin. Di play no be only for entertainment and adventure  but na for di purpose of post-colonialism and wetin di oyinbo pipo don teach us for literature. Dis na play wey turn oyinbo culture round com use am bring out di sweet tin for our culture and believe. Rukewe and Julie na play wey promote our own indigenous culture (i.e Yorubas and di Old Bendel pipo) and original tin join our customised language; Naija Pidgin. Rukewe and Julie na play wey squeeze face for tribalism, e encourage love, peace for among oursef, da na part of di reason e go show for di international pidgin symposium wey go shele June 27 & 28 for Wole Soyinka Theatre University of Ibadan for 7pm wey all di pidgin expert go meet to tok about di structure of Pidgin and how e don grow as time dey go. Any where wey June 27 & 28 meet you for campus or for town for Ibadan, find your way enter Wole Soyinka theatre go watch Naija Shakespeare.   Naija pidgin scholars get dis believe say one day na one day e go be di National language for we country

Comments

Popular posts from this blog

Federal college of Agriculture Moor plantation Ibadan Protest!!!

OAU Disclaims False Post-UTME Online Publications

Notice To Ajayi Crowther University Students